LIFE OF PAINS
Life of Pains
In a world where living feels like pain, lust is disguised as love, care is taken for granted, attention is mistaken for desperation, and mistakes are judged as character, I choose to survive.
Not sure if I could ever be able to prove that I am not abnormal, unlucky, worthless, or useless. Each effort turns into dust; mistakes become shackles. They don't see your efforts, but judge you by your mistakes.
In a world full of people who applaud at your presence and laugh behind your back, who pray for your downfall even when you did nothing wrong, where little efforts are compared to:
"See this one, no be your mate?"
"See that one wey dey carry first class, no be your mate?"
"Shey no be the same time dem born una?"
"Ahh, shey you sef na sickle cell?"
"Like this wey we dey see you, you fit born?"
"Person go marry you?"
"You go reach next year sef?"
Kilode!!!!!!!! Oginiii!!!! Wetin happen?
Na me create myself? Abi na me write my own destiny?
No be my fault say I be sickle cell na.
No be my fault say I get carryover and I no dey first class.
No be my fault say nobody choose me.
Why???? Why e con be like say na me program my life??
Even me, I no fit lie—I DON TIRE.
I NO FIT STAY AGAIN.
When will I stop carrying the pains of wetin I no sabi?
E no fair at all. Lie lie.
Them think say e easy?
One minute, person go dey smile; next minute, e dey try breathe for hospital. E dey feel pains like say make him die. Death no go gree come.
THEM THINK SAY E EASY??
Still, person go package like gala, dey smile like Closeup, just make e no show.
When I dey grow, my papa say na weak person dey cry. But my papa sef cry.
I try to dey carry the pains, but I swear, person don tire.
If life fit do justice for this soul,
me go happy. ❤️🩹
By: Maryam__Otto

![Werewolf Hollow [GALATEA DATE TBA]](https://cdn-gcs.inkitt.com/vertical_storycovers/ipad_76bbf380fa2e8dc2f70694197487ab81.jpg)






